Naija no dey ever carry last when it comes to gbas gbos, and this time around, it’s between two big names—Cubana Chief Priest, Owerri’s finest celebrity businessman, and Burna Boy, the self-proclaimed African Giant. As e be now, the gist don spread like wildfire for social media, with plenty of Nigerians joining mouth for the matter.
How the Wahala Start
Dem talk say wetin cause the whole wahala be one cryptic message wey Burna Boy post for him Instagram story. For the message, e refer to person wey people sharply conclude say na Cubana Chief Priest. Burna Boy yan something like, “No forget say you be Azaman, dem go soon catch you next.” Nigerians no waste time to decode am as shade wey Burna throw for Cubana. Some even begin dey ask, “Shey na this 2025 e wan start like this?”
Cubana Chief Priest, wey no dey take nonsense, no gree make Burna carry last word. Omo, na so he respond sharply with his own gbas gbos. He enter social media, accuse Burna say e dey do like saint but get wahala for hand. He even yarn say Burna owe some London jeweler money and dem never settle. Chief Priest come dey use Burna’s words throw back shade, call am Owerri Rick Ross for one video wey go viral. “Money no fit buy respect,” he talk, making sure everybody hear am loud and clear.